0
Welcome to Warri - Erigga
0 0

Welcome to Warri Erigga

Welcome to Warri - Erigga
Yes
I Dey Always They Tell People Say For
This Town We Get 3 Different Community

Ekpan, Agbasa, & Okere
(Agbasa) If Dem Hold You Say U Thief Phone
U Dey Pay 4 stabiliser and Phone
(Okere) If them Hold U Till Day Break Na Bottom Stairs U dey Sleep But
(Ekpan) If Dem Wan Give U Post Dem No Dey Look Say U Be Indigene
Na The Kind Mark Wey Dey
Ur Body Dem Take Dey Give U Position
If U Get 1 Eye U Be Vice
If Ur Hand Dey Seaze U Be P.R.O
If U Get Bullet Mark U Be D.C
If U Waka Dey Wave U Be Press
(area I hail oooooo) Old Warri

[Verse 1]
Welcome To warri Where All The Mama's dey Vex
F*ck Up No Dey Sawa
She Tatto am 4 Her Breasts
Her Son Dey Press
Two Kala Under Her Dress
She Ready Shoot Olokpa If Them Come Her Address (Rest)
No Be Today She Don Dey See Her arrest
Area Mama 4 D Hood U No Wan See Her Vex
Apart From Cocaine Nothing Mama No Dey Sell
1999 Dem Lock Mama Throw Her Inside Cell
Dem Carry Her Pass Me Where I For Dey Play Monkey Post
They Almost Blast Me With Slap
I Take Off With My Kittos
The First Time I See where Dem Stab Person Neck
Na 94 Two Seconds Naso Andrew Fall
Andrew Mama Dey Bust Cry
Who Do Am Don Run
Full Compound Dey Pack Egbe The Police Dey Come
U Suppose Know Egbe
Dat Guy Matter Na Dead
Him Fit Arrest The Full Area If e Enter He Head
Comments (0)
The minimum comment length is 50 characters.
Information
There are no comments yet. You can be the first!
Login Register
Log into your account
And gain new opportunities
Forgot your password?